EPL Scores: Arsenal 3 - 1 Man United My people, Arsenal don carry Man United come Emirates Stadium beat dem front and back just because their senior brother no dey around

Na Man United first score for first half but wetin vex Man United fans be say Arsenal no even allow dem shout goal finish dem run equalize.


As ball enter 87 minutes, na so Garnacho rush score but referee commot the goal because Garnacho dey offside.

Luckily for Arsenal fans, Ijebu Rice come score for 90'+6, Arsenal no even allow us celebrate finish for viewing centre dem rush add another one to deliver their polling unit peacefully.

As it stands, Man United dey 11th floor for table because dem don play four league matches, win two, lose two and if dem continue with this pattern, dem go follow Dynamo Moscow dey drag Europa League conference next season.

My people, shey Arsenal deliver their polling unit peacefully abi dem r!g am?

Abeg tell us the situation reports for your area make we use am hold body.
Peoplesmind

0/Post a Comment/Comments

Gleetz Magazine Releases The Cover Image Of Its 21st Edition